Di Minister of state for Education, Hon. Emeka Nwajiuba say goment neva give date to reopen universities across di kontri.
Nwajiuba tok dis wan during di briefing of di Presidential Task Force on Covid-19 on Monday.
Recently, some student bodi bin do I-no go gree waka to di ministry of education for Abuja.
Dem call di goment to open school or face dia anger, but di minister for di daily covid 19 briefing say e get high hope say school go soon resume but no exact date yet.
- 'I wan be good police' - Meet di two sisters wey wan join Nigeria police
- Wetin you need to know about Folasade Ogunsola wey be Unilag acting vice chancellor
- Waec expose how invigilators, candidates dey leak 2020 exam papers
- See how Nigerian man wey 'im family chain for 30 years' finally get rescue
- Simple summary and key themes of Faceless book by Amma Darko
Guy Wetin be di latest?
Oga Nwajiuba say dem don review responses from about 78 universities most of dem private universities and dem say dem don ready to open.
For state owned universities, e explain say na 50 percent of dem dey ready and di ministry dey do everytin possible to make sure everybody dey the same page ahead of school resumption.
Di minister of state also yan give say coronavirus still dey and most of di institution neva establish di necessary protective protocol in place.
Before now, di ministry bin don release di latest guidelines wey school must follow before dem reopen for di kontri.
Na since March authorities close down all schools for di kontri sake of di coronavirus pandemic.
Di latest guidelines wey di Federal Ministry of of Education release come as di Nigerian goment release date for resumption of international flight, open churches and mosque across di kontri as dem ease down some of di lockdown restriction.
Guidelines for schools wen dem don reopen
- Training of teachers and oda personnel on safety and hygiene measures.
- Dem must establish Covid-19 referral system
- Dem must make sure say ambulance dey available and dem must get access to testing/isolation/ treatment centres including NCDC helpline and state goment facilities dem
- Dem must make sure say dem get water, sensitization and Hygiene (WASH0 for inside di school premises
- Dem must reduce di number of pipo for dia classroom, hostels worship centres and oda space dem
- Encourage pipo to use open space for gathering and promote outdoor activities
- Dem must get committee wey go dey monitor and enforce di Covid-19 guidelines dem
Guidelines for schools before dem go reopen
- Di guidelines must get different learning option dem for specific learning program wey go make sure say e dey fair for learning
- Dem must review dia policy, practices, and di danger to use schools for oda purpose dem like distance learning centres, temporary shelters, isolation, quarantine and treatment centres, markets, voting centers, and odas
- Dem must develop and display simple protocols wey schools go use operate every day
- Dem must check well-well for anything wey fit cause wahala for dia system and increase di risk of transmission and suggest ways dem go use address am
- Di safety and hygiene for all stages and phases of di school reopening process go promote behaviour wey go reduce di spread like school movement ( to and from school travelling) safe distance, frequent hand washing and di use of facemasks
In case di school no fit fulfil dis option dem fit consider di option to say for house and do online learning. Even dat one too get dia own guidelines
0 comments:
Post a Comment